
French Presido Emmanuel Macron don announce say eight West African kontries wey dey use CFA franc as moni go begin use ECO as di new currency starting from year 2020.
Di West African CFA franc wey pipo sabi as ‘franc cefa’ na di legal currency for Benin, Burkina Faso, Guinea-Bissau, Ivory Coast, Mali, Niger, Senegal and Togo.
Di French goment bin introduce di CFA franc to dia colonies for West Africa for 1945 and na dis same currency wey get links to di former colonial masters for France, dis West African kontris still dey use until now.
Continue reading: https://www.bbc.com/pidgin/tori-50883453